Presido Buhari special adviser, Femi Adesina don dey tell people say mek dem no drag Buhari come out to yan about im health matter.



Femi Adesina , don come out, dey yarn about the approko wey dey fly say, Presido Buhari dey sick.


 CNBC, invite Femi Adesina wey be the Senior Special Assistant to Presido Buhari ontop Media and Publicity matter, yesterday for one interview, where dem for ask am, why presido Buhari, never come yarn give Naija, since im vacation for US, and about the approko wey dey fly up and down say im dey sick.

Adesina yarn say, even as Buhari, be the presido, im still get better right. If you dey drag am come out come talk, nayim be say, you dey try bloke im right, If Buhari no wan talk, na im wish.

Im still yan say, presido dey London for Vacation, Im no dey any Hospital.

Read wetin im talk

"The fact that he is a president, he still has his rights. Compelling him to come out and talk will be infringing on his rights. The president will talk if he wishes to if he doesn’t wish to, nobody will compel him to talk. The truth is that the president is on vacation and he has given a date on which he will return to work" im yan.

"‘The President is in London on vacation. He is not in any hospital and he is not ill. When he was travelling last week, the statement we put out was that he was going on vacation and during the vacation, he would do routine medical check-up and nothing has changed from what we pushed out last week. If anybody has fed something else into the rumor mill that is just what it is, rumor. No substance to it" im yarn.

Previous
Next Post »

Featured Video