FG don tell NBC say, mek dem chuck better eye on why dem dey shot the Big Brother Naija inside South Africa.



The Big Brother Naija wey dey shele for South African, don mek people disturb the Minister for Information and Culture Alhaji Lai Mohammed.

Image result wey dey for Big brother nigeria

The Minister for Information and Culture, wey be Alhaji Lai Mohammed, don tell the National Broadcasting Commission (NBC), to chuck better eye, inside why dem dey shot the Big Brother Nigeria Reality Show, inside South Africa.

For one statement, wey dem release inside Abuja on Tuesday, Lai Mohammed, tell the NBC to go look if Multi-Choice, don break Naija Broadcasting Code, on say dem shot the show inside South Africa, and weather, dem do any wuruwuru inside, as dem no tell people say, dem go shot am, outside Naija.

Im yan this one, as plenty Naija people, don dey play music for im ear, as dem complan, ontop why dem go host the show inside SA. for Naija show again?

Im say mek every body kul down, mek NBC go see wetin cause am, so dem go fit put the matter for ground and clear am.

''As a country of laws, only the outcome of the investigation will determine our next line of action,'' Im talk

Image result wey dey for Big brother nigeria



Previous
Next Post »

Featured Video