CSO dey ready to mobolize boys, if National Assembly no comot Ekiti state Governor Ayodele Fayose from office
One group of Civil Society Organization wey dey under the Coalition for Good Governance and Anti-Corruption, don tell the National Assembly say mek dem come mot Ekiti state governor Ayodele Fayose from office, for say im dey misuse im office.
The group yan this one for one press conference, inside Abuja, for on Tuesday, January, 3.
Dem shout say, the National Assembly get 14 days, to carry Fayose from office, or dem go do national protest.
Audu Joseph wey be the National Secretary for the Coalition yan say, na because of the plenty wuruwuru waka, wey the Governor, dey do inside the state, nayim mek dem want the National Assembly, to carry am from office.
Joseph still yan say, dem meet the National Assembly because the Ekiti state assembly go support Fayose, as na all of dem dey inside the wuruwuru things.
Audu Joseph say 34 Civil Organization stand for their back gidigba, and if dem no carry Fayose from office, dem go do the national protest, as all the Civil Organization dey ready to carry men do protest waka.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
''My name na Peter The Rock, you hit me, you die, I hit you, you die" Ayo Fayose aka peter the rock yarn.Ekiti state governor, wey be Ayo Fayose aka Peter the rock, enter AIT yesterday, where im for
Baba Oyoyo see as youths carry customized Cow to celebrate Buhari.As Presido Muhammadu Buhari don come back from im 51 day medical vacation inside UK, Youths don ent
"Presido Buhari go win again and again" Femi Adesina.Talk talk person, to presido Buhari, Femi Adesina, yarn say, Presido Mouhammadu Buhari go win
Bill Gates, Warren Buffett, Mark Zuckerberg, & More come out for Forbes 2017 Billionaires ListMicrosoft Founder Bill Gates, don come first for the fourth time again for Forbes 2017 Billionaires
ConversionConversion EmoticonEmoticon