"Una demand too much, mek una stop" Presido Buhari tell Nigerians



Today, Inside Daker for Senegal, Presido Buhari don tell Nigerians say mek dem stop to dey mek expensive demand, especially our Ogas dem, wey dey top position for the country.


Femi Adesina wey be special Adviser for on top Media and Publicity matter, for one statement say Presido Buhari don call Nigerians, especially the people wey dey top position(elites) for the country, say mek dem stop to dey yan say mek dem do things the way dem dey do am before, as he dey bring the country down.

Presido still yan say, im administration dey work, to mek sure say, dem give the country better face.
im say for the past 16 year, some past government don spoil, and misuse wetin the country get, as all this don bring bad name to the country.

Read wetin im talk..

 “This administration is pleased we won the election, we are pleased Nigerians are cooperating with us. But the problems are so enormous that we need the cooperation of Nigerians, particularly the elite. ‎They (elite) should reflect on the condition of the country, and stop making expensive demands because things cannot be done the old way,’’

Previous
Next Post »

Featured Video