Multi-billionaire Businessman,Aliko Dangote don Sacks 109 Workers



Dangote Group don sack about 109 workers for their Obajama Company inside Kogi state, after dey fined out say dem dey thife the company properties.


Mr Magaji wey be the Oga for the company patrol team, yan this one give Journalists inside Obajama for today Tuesday.

Im yan say the workers wey dey sack, dey among the 244 suspect wey dey arrest between may and November.
Magaji say people wey dey arrest na drivers wey dey drive anyhow, and other people wey dey thief the company properties, plus people wey dey use Dangote name, dey transport the things wey dem thief.
im still yan say another 155 workers dey prison, dey wait for court to talk ontop their case.

Read wetin Magaji talk

“I am happy to inform you that we have arrested and recovered five stolen trucks; but unfortunately, the products have been stolen.

“It is interesting to note that one of the kingpins, Samaila Yakubu, who specialised in stealing our trucks in collaboration with some drivers and buyers, has also been arrested.
“It is this group that has been terrorizing our trucks in the South East and South South axis,”

Im still come out dey warn drivers wey dey drive anyhow for road.

“We have pasted warnings clearly on the cab of all our trucks prohibiting carrying of goods and passengers apart from company’s products.
“We are calling on the law enforcement agencies to support the efforts of the Dangote Group in arresting those who break the laws of the company,’’  im talk


Previous
Next Post »

Featured Video