Godwin Obaseki don call on religious leaders say mek dem pray ontop recession.



Godwin Obaseki wey dey swear enter office for November 12 don call Naija say mek dem pray for recession.


The Edo state Governor wey be Godwin Obaseki don call religious leaders say mek dem pray wella for recession wahala wey dey inside Nigeria to end.

Im talk this one for on Tuesday wey be December 6, 2016, when the General Overseer for the Deeper Christian Life Ministry, Pastor William Kumuyi, con visit am inside the Government House Edo.

Im still yan say, na prayer nayim mek dem fit run the governorship election as wahala or gbege no show face.
Im say na the first time wey dem hole election for the state and gbege no shelle.

Read wetin im talk.

 “In our state, we have a brand new Oba, in the person of Oba Ewaure II, and a brand new leadership. We believe that with this programme, Showers of Blessing, God’s hand is in Edo, and as a state we would want to tap from the anointing.
“Though we have recession in the country now, we believe it will end. We want you to pray for the state and the country so that the recession will end.”

Obaseki still say

“We appreciate your prayers during the last governorship election in the state. It is the first time in the history of the state that election was conducted peacefully without any recorded incidence of violence.
“We will continue to rely on your prayers and counsel.”

Previous
Next Post »

Featured Video