See tweets Naija Vs Ghana as Naija people attack mr Eazi and Juliet Ibrahim as dey yan say Ghana nayim get Naija music sounds.



Naija people enter twitter, lash mr Eazi and Juliet Ibrahim.


Yes O, the fight wey dey shelle between Nigerian and Ghana still dey trend for twitter, as mr Eazi yan yesterday night say, Ghana nayim mek Naija music get better sound, as Naija dey use Ghana sound.

Naija people never yab mr Eazi finish, nayim Ghanian actress Juliet Ibrahim waka come chuck her mouth inside the matter.

She yan say some Naija sound, na Ghana sound like, Azonto, alkaida, hi-life, and even if you hear "mad or you" you go think say na Ghana person sing am.

Na there Naija people for leave mr Eazi attack Juliet Ibrahim with mouth.




Previous
Next Post »

Featured Video