Money dey say na good thing and every body want am, but wetin matter na how you take fine your money.
Yes today na Thursday, and wetin we dey do on Thursday? throw back things.
This na Naija celebs, wey don see as life be. but dey won really mek that money, so dey pursue their dream and passion.
As today be throw back Thursday, we for kwekeO say mek we share throw back pictures of our ogbonge celebs, wey dey mek Niaja lively, as we believe say, this pictures go mek you stand up and do wetin you suppose do.
We know say, you no wan see yourself for the same position as you dey 10 years Ago.
Oya see more pics..
 |
IME BISHOP UMOH aka Okon. the guy never change, the character still dey im blood right from small |
 |
TIMAYA Agberipapa 1 of Bayelsa, that year wey im carry church for head lolzz |
 |
The don imself Don Jazzy, the man still dey up to something, but na that wedding bell we dey expect |
 |
Small boy turn biggi man Korede Bello, learn from this guy or im go arrest you, na police o |
 |
Banky W the man is still kin kin, as im head still dey the industry, hope say the wedding party go come alive upon your life , but no issues. |
 |
who know say Yemi Alade go be Mama Africa?, My sister think big like her. |
 |
I still dey wonder if Adeleke get money that time wey Davido take this shot. okkk no wonder "I remember wen the girls no dey come arround, I remember when i had no money in my bank account" complete the rest. |
 |
2Baba you really be baba, be like am. Nothing dey happen. |
 |
Akex Ekubo. this guy don see im future before im mille born her. |
 |
Phyno Finno the baddest kullest Naija rapper |
 |
Nabania money don show. |
 |
Pantoranking wahyaseh, men the bros don already mek plan for this day |
 |
Started from the bottom, dem know where dem dey go. |
 |
Olamide and gang the man still dey ontop im game |
 |
Seyi Law we await your swearing in as Naija presido, come 2019 |
 |
Father amd Son wink, AY and Alibaba, you fit become anything you want no matter where you dey. |
 |
All na fashion. for im mind that year "I killed it!!!" |
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
ConversionConversion EmoticonEmoticon