Dey don set new date for Presido Buhari duaghter wedding after dey prospone am.



Dey don set new date for Presido Buhari daughter Zahra Buhari and Ahmed Indimi after dey been prospone the date.
                                                       

President Buhari daughter Zahra Buhari wey be graduate of microbiology from the University of Surrey, England and ambassador for SCAF and Ahmed Indimi wey be son of billionaire, Mohammed Indimi, and marketing director for Oriental Energy Resources, go marry for this month.

Dem been set the date for December 2, 2016, until we hear say presido Buhari say mek dem prospone the ceremony.

We still hear say the president, want mek dem do the ceremony codedly, say im no like how people and media dey chuck eye inside the matter.
                                                     

News enter town say the groom family give Zahra Buhari 30 expensive Louis Vuitton bags, say this na one of the things wey mek the president prospone the date before.

Now another invitation card don show, as dem don put new date wey be December 16, 2016.

Read the invitation card

“H.E Haj Aisha M Buhari cordially invites you to the wedding Fatiha of her daughter Zahra Buhari and Ahmed Indimi which will take place on December 16th while the Kamu will take place in Abuja. Details of the events will be communicated to you,”  reads the words of the invite.



Previous
Next Post »

Featured Video