Police arrest man wey kill im step daughter, sell the head for 3K



The Ogun state Police Command don arrest won 63 years old man wey name na Korede Odubela for say im kill im 16 years old step daughter wey name na Amudat Oshimodi, con sell her head.


According to Vanguard, the man sell the head for N3000.
Dey say this one shele for Imosan Area for Ijebu Ode local Government area inside the state. dey still say the man carry this killing, with one other Person wey name na Lekan Lawal.

Odubela and lawal tie the small girl leg and hand, con cut off her head, wey dey con later sell give Odubela son.

When Police look into the matter wella, Odubola say na the mama of the girl nayim instruct dem to kill her cause she too dey thife her money.

Read wetin im talk..

"It is true that Lekan Lawal and I connived to kill my step-daughter. The girl was 16 years old. She was always stealing her mother’s money. And the mother said we should kill her as a sacrifice for the other children she had. Since she normally slept at the door post outside, at 12 midnight, I invited Lekan Lawal. He held the girl by the neck and strangled her while I held her legs. That was how she died.”

When dey ask the mama, she deny say na lie oo, she no instruct dem to kill the girl o, she agree say yes o, the girl can thief for Africa, but she no say mek dey kill the girl.

Police yarn say dey go charged the men go court.

Previous
Next Post »

Featured Video