Lagos state Police commissioner Fatai Owosemi don announce the arrest of 17 police, for say dey collect bribe.



The Lagos state Police command don announce the arrest of 17 police, for say dey collect bribe.



Fatai Owosemi wey be the State commissioner for police inside lasgidi don come out dey yarn say dem don arrest 17 police wey dey chuck hand inside bribery and dey spoil police name.

Dey arrest the Police dem between October 6 and 26.
Punch Metro report say Fatai Owosemi, still tell country people say mek dem report any police wey collect bribe or do any wuruwuru.

Now the police wey dey arrest dey under trial. dey fit sack some and demote some.

That same period nayim the  police command for arrest 26 arm robbers and 18 kidnappers.

Read wetin  Fatai Owosemi talk

 “A total number of 17 policemen were arrested in different areas of the state for misconduct. The necessary disciplinary measures are being taken against them.
“The command is alive to its responsibilities. We have zero tolerance for crime. Also, a total of 26 armed robbery suspects and 18 suspected kidnappers were arrested by the command. We recovered two AK-47 rifles, 14 locally-made pistols and 193 live cartridges from them.
“In the different police operations, 17 vehicles were recovered from criminal elements, while 11 mobile phones were also recovered.”

Previous
Next Post »

Featured Video