See why we need to sell National Assets:: Federal Government.



Federal Government don come out dey say, dey won sell Naija National Assets, as dem no get any other option.


The federal Government talk this one, Sake of say, money no dey to take fund the 2016 Budget.

And the project wey dey won do as dem writam for the 2016 budget, go support the Economic diversification agenda, but dey never do the project, sake of Government Revenue just dey fall anyhow.

Udo Udoma wey be  Minister of Budget and National Planning talk this one on Saturday, September 24   for one statement, wey im Media Adviser , Mr Akpandem James give.

Im say the government don loss almost half of their revenue for this year, nayim con mek the Economic Management Team waka go the fiscal stimulus plan.

Im say the plan na to bring better  funds enter the economy. and dem go get this funds from  Naija property wey dem go sell, collect licences rounds before the day wey dem suppose collectam, con use those funds wey dem collect from Politicians wey carry money run.
Minister of Budget still say this fiscal stimulus plan na to get funds shappaly shappaly to take brings back the economy, and no be say na to sell all the major property wey Naija get.


Previous
Next Post »

Featured Video