Justice John Tsoho comot hand from IPOB leader, Nnamdi Kanu Case



Justice John Tsoho wey dey put eye for the leader of Indigenious People of Biafra IPOB, Nnamdi Kanu case say im no won put eye for Nnamdi Kanu case again.


Justice John Tsoho nayim be the judge wey dey handle  Nnamdi Kanu case, im say in no handle again again as im send case file back to the  Chief Justice of the Federal High Court, Ibrahim Auta.

Tsoho talk this one  sake of say Nnamdi Kanu legal team put petition for im head say Tsoho dey do i know you, i no know you ontop  Nnamdi case.

Na Chuks Muoma nayim lead  Nnamdi Kanu legel team. 
Chuks say dey no trust Tsoho at all, and im no dey do as im suppose to do ontop Kanu case, say na as the federal Government tellam, nayim im dey do.

Read wetin Tsoho talk
“I have no interest in trying your matter and I will return it to the CJ, but I will condemn the attitude of that counsel. I do not care if you take your case to another planet”


Previous
Next Post »

Featured Video