2yrs old musa wey step mama break bones anyhow enter school today after months of treament



Abi Una remember that small boy wey im  step mama break im bones any how, yes im don start school today


Sani Maikatanga wey be Picture journalist post this picture of Musa im Mama Bilikisu and sister. as dem dey enter school today.
Im step mama break im body anyhow some months ago, that time im dey 21 months old

Mrs Aisha Buhari nayim carry the small boy enter Abuja for treatment on the 6th of June as she hear say im step mama break the boy hands,legs and tongue con blind im right eye con comot the small boy penis.

but thank God for the small boy. im don well gidigba.



Previous
Next Post »

Featured Video