Fulani Heardsmen Kidnapp Catholic priest demand for 2.5 million Naira



Fulani Herdsmen gbege Catholic priest Rev Fr ChetannaFr Emmanuel Dim and Fr Prof Ezeokana for Enugu




This one happon for Enugu State for on the  26th of Sept. Report yarn say Rev Fr Chetanna Jude Chukwuneke, Fr Emmanuel Dim and Fr Prof Ezeokana dey inside moto, along Obimo inside Uzo-Uwani before this Fulani Men comout from bush con gbege dem.

Fr Chukwuenke and Fr Prof Ezeokana borrow leg escape but dey con kidnapp  Fr Emmaniuel Dim as im no see leg borrow. 
Now the Fulani men say dey want 2.5 million Naira before dey go releasam.

 Rev. Fr. Hygi Aghaulor wey be the Director of Communications for the Nnewi Catholic Diocese nayim talk this one. im still say mek we join habd pray mek  dey release the priest.

 The catholic Bishops Conference don comout dey talk say, dey no go pay any money.

Read wetin  Fr. Hygi Aghaulor talk ontoip the matter 
“We call on people of goodwill to continue to pray for the immediate release of the Vincentian priest. We are tempted to wonder if Nigeria is on the verge of collapse. All over the country, women are being raped and intimidated, innocent Nigerians are being slaughtered,’’ 


Previous
Next Post »

Featured Video