Police arrest Moroccan boxer wey suppose to fight for Rio 2016 Olympic for say im try to rape two girls



Moroccan boxer try to rape 2 girls for Olympic village.



This 22 year old Moroccan boxer, wey name nan Hassan Saada. Brazilian police don arrestam sake  say im try to rape two girls for the Olympic village for Barra de Tijuca inside Brazil on Tuesday morning

 Police say, Saada call one of the girls say mek she con take selfy witam kaki anoda plan dey im mind.

As the matter be im push the girl enter wall con dey try to touchlight her for mouth. im pam the oda girl for her breast con dey do touchligting, say im go give her money.

Saada suppose to fight with Mehmet Nadaradade Una,  wey be Turkish competitor  for on saturday August 6th, but now im no go fight again as dey don comotam from the competition cause of the bad thing wey im try to do.

Read wetin Police talk
“It has been necessary to arrest Hassan Saada to investigate the allegations against him. If he was at liberty there would be a risk that he could interfere with witnesses. And there is a risk that Hassan Saada could reoffend.’” said Judge Nunes Saly, stressing that Brazilian laws apply to both Brazilians and visitor"


Previous
Next Post »

Featured Video