Police arrest 22 Teenergers for Robbery.



Rapid Response Squad (RRS) for Lagos State Police Command don arrest 22 small boys and girls for thief thief and bad cult wey dey join.


For the 22, four na girls wey go robb their own, dey arrest dem for Agege side.

two oga  wey names na Babatunde,  15 and Tayo,15 for  the first gang, wey eight members dey inside.  police arrest dem for on Thursday for around 11:30 p.m. inside Mulero, for Agege for say dey robb  Aladegbo Abidemi with axe, con collect her Blackberry Z10.

So dey con later catch the other members of the gang Matthew, 18; Sakiru, 16; Ganiyu,13; Reliwan, 15; Ibrahim, 15 and Kudus, 15

Read wetin Aladegbo Abidemi, talk.

“I was coming from work. I decided to pass through Mulero to link the closest bus stop around 10:00 p.m. I sensed my phone ringing and I picked it. Just few seconds while on the call, I noticed some young boys about 12 swarming like bees towards me.I ran but I fell down. They rough handled me, threatened me with an axe and took my phone. They retreated and abandoned me inside the gutter.A couple of minutes after standing up, I saw RRS patrol vehicle. I reported the incident and showed them the direction they went. They gave them hot chase, and arrested them with my phone”.



Police carry The second gang, wey 10 boys and four girls dey for on Monday around 02:35 am, for computer Village, ikeja for wen dey go thief phone inside phone store,  boys wey go thief na, Sulaimon, 13; Godwin, 19 and Sunkanmi, 15,

Dey enter the store con do as if dey won buy phone, befor the seller know, dey don carry two phone, but dey catch dem sha.

As the matter be the children be cultist, dem dey Eiye confraternity
Names of the boys na Taiwo, 17; Rotimi, 17; Lateef, 19; Tunde, 17; Bolawatife, 15; kayode, 15; Olamide ,15.
 Girls na Olamide, 19; Agnes, 14; Ayo, 15 and Ope, 16.
       


Previous
Next Post »

Featured Video