Soldiers and police exchange bullet for Borno state cause of Food



Gbege enter Borno state today, as soldiers and police exchange bullet cause of food wey Govenment distribute for Ramadan fast

Dey say Government don dey share food items give those people wey no get money,and police don say  mek no moto enter the  place, wey dey for dey share the food items

.Army con come say dey won enter, but police con dey think say, the soldiers won come collect their own share,so dey tell dem say mek dem go back

Soldies dem con  para, sotee dey shot one police for leg, fight con start o  as Bullet just dey fall like rain, people dey run comot from the rain.

But later later, the Borno State Attorney General, Kaka Shehu Lawan con call Major General Lucky Irabor wey be the commander of the operation Lafiya Dole say mek him run go off the fire for there

Oya Read wetin Irabor talk
“What is a bag of rice that will give you the cause to be angry? Bag of rice? It is shameful. If the world hears that it is because of bag of that made police and soldiers to be fighting, is it not shameful? Let us not behave like children: all of us have children at home. Soldiers and policemen should be seen to be matured in their dispositions at all times.While everyone is clapping for good that we have been doing, let us not also do things that will make them to begin to stone us. I want you to calm your nerves, because in a family you are likely to find incidents of misunderstanding,” 


Previous
Next Post »

Featured Video