see photo; pikin wen dey born with heart outside chest



The mama of the small pikin, Falmata,tell us say she think say she don born twins after she see the heart of her pikin wey dey pump outside her chest.na there nayim Falmata con know her pinkin condition wen dey rusham go general hospital for Geidam, Yobe State from their village, Gonigori.

She con still say she no feel anything tru out the time wen she carry her oda 3 pikins belle.

Falmatashe con still dey say she never hear anything wen dem dey call'Antenatal,wen dem dey give women wey get belle, she still say she born her pikin for house say na traditional birth attendants help her.

 wen dey ask the papa of the pikin wen him na MUStapha wherder him don hear anything about antenatal care, the papa of the pikin say women no like  antenatal care due to say dem dey fear wetin male staff go do to dem.


the Chairman of  the UMTH Medical Advisory Council, Dr. Mohammed Bashir Tahir, tell correspondent say many people don come out say dey won help pay for the surgery bill,con still say dem go transfer the pikin go Enugu State for the surgery.

Previous
Next Post »

Featured Video