Read wetin kweke o tink about 2Baba song ''Oya Come Mek We Go''



All of us know say 2Baba na one unique singer inside the Naija music industry. all the music wey him sing dey mek sense, as  you fit learn something from evry music.
Him feature SAUTI SOL for  for this song wey him call ''Oya Come Mek We Go'' this song  mek sense die. Nayim mek we for kweke o won talk wetin we tink for inside the song.

Oya read wetin we tink

''For everything  wey you dey do for life, no let anybody bring you down,No let anybody tell you say you no fit mekam or you  think say you no go fit mekam.''

'''Wen our parents dey small, dey get big dream. Some fit say dey won be engineer, doctor or pilot. We self na so we talk wen we dey small. But the journey no easy.  But people dey waka pass  the road. Dey try to get wetin dey want . dem wey don mekam no get two head or five eyes or their brain big pass your own..''

''Na your mind set nayim matter, because if you think low of yourself, wetin you want, you no go get am. I believe say dangote face plenty chanllenge befor him become wetin him be.. him don go look how dem dey doam and con mek sure say nothing drag am go back.''

''If you no knock, door  no go open, if you no jump you no go fly… and na so life be.. just as small pikin dey try to mek sure say him waka. Life na jeje . but the koko be say, If life dey show you pepper , bros mek  pepper soup from am..



Na wetin we for  Kweke o tink…


Previous
Next Post »

Featured Video