Read wetin Kweke o! think 🤔 About Sound Sultan song ''MotherLand''



Wetin We Tink

Yes o!!! Anywhere you go, no forget your Mother Land.
Una remember Sound Sultan song MotherLand. Today, kweke o go talk wetin we think  about Sound Sultan song MotherLand.

Yes as we think for  2baba song,  na so we won think for  Sound Sultan song.
 Anytime  dey sing, sense dey come out, and we know say sound Sultan don tey for the Music Industry and the guy still dey mek sense for every music wey him sing.

This him song MotherLand don mek we for kweke o think out of the box, say mek we pass the koko of wetin him dey talk.

Oya see wetin we think.

We don get plenty people wey don travel comot from naija, cause of the problem wey we dey face.

But the koko be say, if you comot from your country no forget you family,people wey you leave behind always remember dem
Anoda be say, you wey dey travel. The thing wey you go fine for anoda country, dey your country but na for you to think how you go take mekam for this your country, because majority of people wey travel  go Yanki, no be all of them get money. Some dey wish say dem dey Nigeria, some na work, wey dey no fit do if dem dey naija, nayim dem dey do.

But the main koko be say, anything  you dey do, mek sure say you dey doam well. And no forget people wey help you.
Think out of  the box, mek you mek sure say you mekam for your country.

If na travel, mek sure say you bring better come back, anywhere your  leg carry you go, you go still enter your mama land cause no place, like home.


Na wetin we for kweke o, think about  this song…


Previous
Next Post »

Featured Video