Aproko don comeout say Dj cubby dey date former west brownwich player.
DJ Cuppy wen be billionaire pikin, as we dey talk like this dey for vacation with her boyfriend and the two of dem dey enjoy dem self wella for spain.
dj Cuppy say na true say him dey use bullet proof motor anytime she enter lasgidi, she con share pics of she and her bf for snapchat,and she no want mek nobody know who her boyfriend be, as she use emojis take cover her boyfriend face for plenty pics wen dey snap together.
eh eh,nayim one persin enter Twitter dey say Dj Cubby dey currently dey date the former West Bromwich player.
as him talk, him say him see she and one persin wen dey attend wedding for mollaroco and dey sit down for the same table.
but Dj cubby wen be 24yrs say she no dey hid anything but she won dey careful befor she post anything about her boyfriend.
Read wetin she talk
"I think it’s important to have a private life… When everything you do is under a microscope you have to be very careful with what you put out into the world. It’s not that I’m hiding anything I’m just being careful with revealing who my boyfriend is" DJ Cuppy talk.
The billionaire daughter relcently graduated from the New York University Steinhardt School of Culture, Education and Human Development.
ConversionConversion EmoticonEmoticon