Photos: President Buhari don appoint Muhammed Babandede as acting Comptroller-General for Immigration



Presido Buhari don appoint Muhammed Babandede as the interim Comptroller-General for Nigeria Immigration Service, (NIS). The former immigration oga wen him name na Martin Abeshi who Presido apoint on August 27, 2015, say dey don sack   am as him hole the position for six days as na acting him been dey do.


Na Lt-Gen. Abdulrahman Dambazau(rtd) who be the Minister of Interior on Tuesday, May 17 na him sign the letter wen comot Abeshi.  For the letter dey write say: 'notification of retirement'. The letter direct Abechi say make him hand over to Babandede quick quick..
Vanguard say the reason wen dey sack Abeshi na because of the   recent replacement wen dey do for the service. Dey say him employ him third wife and him most senior pikin inside the service. Say Both of them  dey under-go training for Kano.
Until yawa con gas, Mr. Babandede na him dey incharge of the Operations and Passport Directorate for the service.

Previous
Next Post »

Featured Video