Davido don set to sponsor every every wey concern the small boy wey sing im song, after video enter everywhere for social.



5 days ago, video of this small boy enter everywhere for social media, as the boy sing Davido "IF" song, But God bless the boy life, as Davido don set to sponsor every every wey concern the small boy.


As the matter be, the person wey video the samll boy, yarn say, the boy wey name na Utibe, no dey go school, but im dey enter bush, dey look for snail dey sell, as to help im mama wey be physically challenge person.

Sham Rock, wey share the video, do eyahh ontop the boy matter, Im visit their house con see say, Utibe mama no get husband, and to mek matter worst, she dey paralyzed and she still get 4 children, wey dey depend on her.
The house wey Utibe dey stay, don scatter finish.

The Guy, carry Utibe enter school today, Utibe dey primary 1 for one Government Central Primary school Ibeno, Akwa ibom state, the guy, con share picture of the boy first day for school.

The Good Samaritan, don yarn say, Davido, don promise say, im go fine beta house for Utibe and family.

Read wetin Davido yarn ontop the matter for Instagram.

"OBO GOT YOU FOR LIFE KID!!! NOTHING MAKES ME MORE THAT U FINALLY GET TO START SCHOOL!! 30 billion for ur account oooo!!!! 🙏 WE RISE BY LIFTING OTHERS!!"
  


Previous
Next Post »

Featured Video