95 Males and 2 Females, land for lagos Airport from Johannesburg, enter Lagos after dem deport dem from SA.
As the matter wey concern xenophobic dey go, as SA people dey gbege Naija people, wey dey SA, SA government don come out, deport 97 Nigerians, for say dem commit badness.
The 95 males and two females wey dem deport, enter Murtala Muhammed International Airport, Lagos on Monday night,
DSP Joseph Alabi, wey be Spokespersin, for the Lagos Airport Police Command, yarn say, yes o, this people don enter Naija from SA.
One immigration person, yarn say, 6 of the people wey dem deport, dey sell drug.
Dem arrest 10, con deport dem, for other badness, wey dem carry hand do.
As he be, some no follow immigration law inside the Southern African country.
Nigeria Immigration Service (NIS) don look the people wey dem deport wella, con carry the once wey dey sell drug, give police, to chuck eye inside their matter wella.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
Recession wahala: 26 years old man kill imself for Niger state.One 26 year old man, wey name na Okafor, nayim we hear say, kill imself, as im hang imsef, for Rock
Facebook user yarn how Ikorodu people nearly killam based on say dem think say na member of Baddo cult.One Facebook user wey name na Akinrinlade, don share for facebook, how Ikorodu people nearly kill a
Covenant University, don suspend 200 student, for sey dem no attend the school Easter program.Dem don suspend 200 students wey dey the Covenant University, Ota, Ogun state, for say dem no atten
Step mama lock and starve 3 children inside room after their papa travel.One Stepmama inside Kano state , nayim we hear say lock these three pikin inside one room for their
ConversionConversion EmoticonEmoticon