4 Things wey you need to know, about your future Bae or Boo before you jump enter any lovy lovy relationship.



Wetin be that make sense things, you dey fine for your future boo and bae body, to mek jollification full your relationship?

Image result wey dey for relationship

We don look every Conner, dey look for that person wey sabi play love wella, and get beta character, as dem go mek your relationship mek sense.

Many of us don write list down, dey yarn wetin we go like see, for our future boo or bae body, as na correct person everybody want. abi who no like beta thing?

Some of the things, wey some people like to see, for their boo or bae body, na may the person dey smart, kind, funny, like to go places wella, and may the person understand, the way things dey go, for your life.
 Plus, Person wey sabi cook, wey like ball, wey sabi politics, and wey like to travel wella.

But one thing be say, all this things, no fit dey one person body, but the koko be say, you need to understand wetin you want, and if you understand wetin you want. then your relationship go mek brain, as na only jollification, and lovy lovy things, go dey shelle.

But wetin be that main things, wey you need to chuck eye, before you jump enter any relationship.

Oya see dem..

1. look if the person go give you advice, dey loyal, and understand you wella.

One thing about people be say, dem like person wey fine well well, person wey kind, and may the person funny and hole money like kilode, and get make sense job.

But no forget to follow person, wey go give you advice, and tell you things, wey you need to know about life, person wey go push you, do wetin your mate dey do, just because say im want your progress for life..

Image result wey dey for understand your gilrfrend

2. Fine person wey dey think, and do the way, you dey do (Similarity).

Abeg, fine person wey dey think, or dey do wetin you like, as research don show say, people wey get the same character, and thinking things, fit marry, sake of this resembleness things.
see eh, love go boku inside your relationship

That same oyibo, don still do research say, husband and wife, wey get the same taste, no fit fight inside their lovy lovy relationship, as dem like the same kind of food, get the same hobby, and many other things.


Image result wey dey for loyal, undersatnading relatioship

3. Follow person, wey you trust wella, Oyibo callam "Conscientiousness". 

My brother, fine person wey you fit trust, person wey no go fall your hand, person wey you fit depend on, person wey dey humble, and dey do their things well.

This kind people, dey meke sense for relationship, as your relationship go last, as dem go bring their mek sense character, enter your life.

But people wey no get this kind character, dey promise and fail, dem like to conceal plan, and dem  dey do things,  as if dem no send, in short, dem go fall your hand, join your head. shine you eye.

Image result wey dey for similarities in a relationship

4. People wey their ways dey change..

People wey their ways, dey change, dey quick vex, dey like to do things gidigidi, dem dey always rush their things like say tomorrow no dey, and dem want mek things shelle shapshap.

This people get bad mouth, dem like to argue ontop matter wey no concern dem, and dem dey quick jealous, and forgiveness, no dey their bible.

Abeg shine your eyes wella o, before you enter this kind people life, cause, na only wahala, and kasala, go dey shelle, inside your relationship.

Image result wey dey for changung ways in relatioship



Previous
Next Post »

Featured Video