Benue state police command don arrest this woman for say she kidnap two children from their house for Makurdi, Benue state.


One Facebook user wey name na James Orngu, nayim post the picture for Facebook, im yarn say this woman kidnap this, small boy and girl for Makurdi, con carry dem enter Anambra state.
Police gbege her for Aliade, when dem dey go Onitsha.
As police dem chuck beta eye inside the matter wella, the children yarn say their papa name na Sarwuan Zaki from Gbonko Church, around Modern Market, Makurdi.
The two pikin, and the woman wey kidnap dem, dey under police custody for Aliade Police Station inside Benue State.
ConversionConversion EmoticonEmoticon