Check out the 5 simple Correct tips, wey Person need to do, to Keep Body and health matter Clean.



If you dey take care of your body wella, and dey do, wetin you suppose do, to keep you self neat and clean, that one, na sure thing say, James and John, no go enter your life.

Related image

If you dey keep yourself neat, like dey wash hand, brush teeth, and even dey scrope yamayama, wey oyibo dey call, virus and bacteria, from your body, both morning and night. just know say, your health condition, go mek sense, as you go dey carry shoulder up, dey demo dey pose, sake of say, your health condition, mek sense.

But my brother, if you no dey take care of yourself wella, na only you, go dey run from your self. as you go dey smell, your hair be like mad man wey dey form big boy, the hair for your armpit, long like daddy showkey dreadlocks, and your mouth odor, dey pursue fly, sote mosquito, dey fear to bite you.

See eh, na only you, go dey yarn yourself say, you no try, as people go dey run from you, and to waka for road, go be problem, sake of the bad condition, wey you don put yourself.

But the tori wey we put for here so, go yarn us wetin we fit do, to mek sure say, we get better health condition.

Oya check out the things, wey you fit do, to keep your body clean.

1. Dey baff everyday: No be to pour water for your body, con run commot from bathroom o, na to use better sponge and soap, take wash your body wella, especially part like armpit, and private body, as na all this place, nayim disease dey quick catch.

Related image

2. Try dey cut your Nails: if you no dey cut your fingernails, nayim be say, you dey welcome  yamayama wey be infection and bacteria.
As e be, some of us dey use our hand, take dey hammer correct food, like EBA or Akpu, and as the food dey land enter our belle, na so bacteria, dey follow land, join the food, enter belle.

Related image

3. Brush your teeth: As common sense take put am, you suppose brush your teeth, after every food wey you wack, even self, two times everyday, as he dey help commot some bacteria, from your mouth, wey go make your mouth smell, and wey go make your teeth rotti.
The worst matter na, if yamayama wey be bacteria, con enter your gum.  ah that one na another palava, as oyibo fine am say, bacteria for gum, dey affect heart too.

Image result wey dey for cleaniness brush teeth

4. Abeg dey wash your hand: Wash your hand, before you wack, before you even cook the food, way you won wack, and after you use toilet, and bathroom. cause the same hand, nayim you go use, cover your mouth, when you dey cough, or when you sneeze.
when you troway dirty, mek sure say you wash your hands, with detol, sanitizer, or even soap, if na that one you get. If you do this,  bacterial and disease, go tear race, from your life.

Image result wey dey for cleaniness


5. Sleep wella: Plenty sleep, nayim win o, say like you crash for like 8 to 10 hours, you go see as your body go take recharge like phone battery, you go stand fit gidigba die, and your blood go stand gidigba, dey fight sickness, wey James and John carry waka come.

Image result wey dey for cleaniness sleep

Na this small gist, wey we don nack una, nayim dey on board, for you to use, as he good for body, he no dey hard to do, and he go give you high morale, to dey do things.

Previous
Next Post »

Featured Video