Timi Dakolo bring proof to show say im no thief Majek Fashek song, after Majek threaten to sue Timi for N100m.



Singer Timi Dakolo and Majek Fashek, matter don enter ground, as Majek Fashek management, threaten to sue Timi ,ontop N100m matter.

Image result wey dey for majek fasheck and timi dakolo

This matter enter ground, wen  Majek Fashek management, yarn say Timi Dakolo steal Majek song ‘Send Down The Rain’ and say dem go carry the matter enter court, since Timi Dakolo, go against copyright laws

But The singer, Timi don yarn say, im no steal anybody song, but im follow the legal part to collect the song, say im pay Majek Management before in collect the music.

As the matter don reach Timi neck, nearly enter im nose, nayim Timi, carry many prove, to show say, yes, im pay before im use Majek song.

For the document of agreement wey Timi bring, he show say, Charles Novia wey represent Majek, sign the document,

Charles Novia sign the receipt. Dakolo con still show the public, one copy of the bank teller, wey dem use pay 500k, for bank.

see proof below.





Previous
Next Post »

Featured Video