#KwekeQoutes "Live your life well, Even when person badmouth you, nobody go believe dem."



"Live your life well, Even when person badmouth you, nobody go believe dem."


Dem say the way you dress, na the same way, dem go take yarn your matter.
For anything you dey do, weather for social media, or for face me i face you, people dey watch you.

Every body get enemy, and people wey go won spoil you, give another person.
But na the way you live your life, nayim people go believe their badmouthing or not.

This badmouthing thing, fit put person for wahala.

Bad belle fit lie for you head. but if you live your life well and people trust you, nothing go happen to you, but if no be you do am, and your life dey one kine, and nobody trust you, den na you do am.

watch how you dey live your life, so you no go enter wahala, wey your head no fit carry.


Previous
Next Post »

Featured Video