#KwekeQuotes "If you work just for money you no go get am, but if you love wetin you dey do. success go be your own" Ray Kroch.



"If you work just for money you no go get am, but if you love wetin you dey do. success go be your own" Ray Kroch.


I don see many people,  wey won get one job, or the other, because say, dem hear say, money dey inside wella. But no be because of say, dem like the work, na because of the money wey dem hear.

Even most of our school children, dey enter science class, because their parent force dem, or dem force demself, still because, dem fit work for oil company, where money boku.

But one thing, wey people dey forget be say, no be everywhere, your head fit enter. God don schedule your life, put for one side, you need to follow that part.

No wonder, this quote dey yan us say, if you dey work because of money, success no go come, because you no go, go far. You fit stop, after you realize say, you no get  joy, dey do the work.

But, if you put head down, work for wetin you like, with faith,determination and hard work, betterness, nayim go dey follow you.


Featured Video