"King Invincible" Ogboge film by Femi Adisa go premiere on 4th January you need to watch.



This film King Invincible na one ogboge film wey Femi Adisa release.

Dem don nominate this film for the African Magic Viewers Choice Award for best Costume Category.

King Invincible na one ogbonge film, wey dey yan about one Yoruba King wey name na Taari, but things no go well as the king start to change to wolf, sake of swear wey dem put for im head.

As the matter be, king Taari must fine way to stop this swear, wey bad belle people put for im head, or im go be wolf forever.

But one prince stand gidigba say if King Taari no fine the cure, to this wahala, im go become the new king.

Image result wey dey for kind invincible femi adisa

people wey art the film na Gabriel Afolayan, Tope Tedela, Omowunmi Dada, Toyin Alausa, Bimbo Manuel, Segun Dada and many many others.

dem go Premiere the film on Wednesday, January 4th, 2017 for Film House IMAX Cinema inside Lekki, Lagos.
Dem go show the film for all the cinema inside Naija on Friday, January 6th, 2017.

Previous
Next Post »

Featured Video