Fayose stop DSS as dey plan to arrest Pastor Johnson Suleiman after im tell church members to kill Fulani men.



Fayose stop DSS as dey plan to arrest Pastor Johnson Suleiman

Apostle Johnson Suleiman

Ekiti State Governor, Ayodele Fayose, for early mon today Wednesday, stop the Department of State Services (DSS), as dem won arrest Apostle Johnson Suleiman, wey get Omega Fire Ministries World wide inside Ado Ekiti, Vanguardngr yan.

The Pastor, been tell im church members, say mek dem kill any Fulani herdsman, wey dem see.

The Pastor, wey enter Ado Ekiti for one two-day crusade, Fayose self attend the crusade.

DSS, Follow the pastor enter im hotel, and dey try force dem self, enter inside im room, but security men block way for dem, as dey ask dem, wetin dey come fine?.

Na there, dem for tell the Pastor, wetin dey shelle, im con call Governor Fayose, wey come with men, to stop the arrest, con still carry the pastor, enter safe place for around 2am.

Read wetin im yan.

 “I came to Ado Ekiti for a crusade. But I had a premonition that I was being trailed after I preached that Christians should retaliate any attack or killings by the Fulani herdsmen. .

These Fulani headmen had turned many Christians to orphans and widowers but the time has come to protect ourselves. When the men of DSS came in the middle of the night I knew their mission and I had to call the Governor because if they arrest me, they will put this country in fire."

Governor Fayose, still yan ontop that matter ,im say DSS Wakajugbe follow the man of God, say DSS for call am, before dey carry the arrest.

Read wetin im talk

 “Are Christians and Moslems under different dispensation of the rule of law? We are not in a fascist state, FG must learn to respect the rights of Nigerians and freedom of expression.

This is unacceptable, We are in a democracy and Nigerians should warn the Presidency against putting this country on fire because religion is an emotional thing."



Previous
Next Post »

Featured Video