Dem suspend one "Saturday Night Live" writer for say she yab Presido Trump pikin Barron.



Dem don suspend One "Saturday Night Live" writer, after she yab Barron Trump, wey be Presido  Donald Trump youngest pikin.

Image result wey dey for baron trump

For on Friday, wey dem swear for Donald Trump , One writer wey name na Katie Rich, tweet for tweeter, dey yab the 10 years old Barron Trump.
The tweet, mek plenty people chuck mouth for social media, as dem lash her like say tomorrow no dey.

Dey lash her sote, dey tell NBC to sack Rich. and many people don support this sacking. 


Rich delete the tweet, and her Twitter account. she con later activated the account on Monday, so she go beg people to forgive her.

"I sincerely apologize for the insensitive tweet, I deeply regret my actions & offensive words. It was inexcusable & I'm so sorry."



Previous
Next Post »

Featured Video