Police arrest Alhaji wey dey supply weapon give Fulani herdsmen for Enugu.



The Enugu police don catch one Alhaji Garuba for say im dey supply weapons give Fulani herdsmen.

Police arrest Fulani herdsmen's weapon supplier

As he be, this Fulani herdsmen don dey gbege everywhere for the state, as dem don attack people, farm and plenty other things for the state.

Punch yan say Mr Ebere Amaraizu wey be the spokespersin for the Enugu state police command, say dem catch one Ibrahim Adamu with AK-47 inside Udi area for Enugu on August 29. Ibrahim Adamu nayim tell dem say na Alhaji Garuba dey supply weapon give dem.

Since dem arrest Adamu police don dey pursue Garuba. ontill dem don catch am for on December 6

Dey catch Adamu wey implicate Garuba inside bush for Affa community.
Adamu come from Nasarawa state and dey arrest am with Ak-47 assault rifil 24 rounds of live ammunition.

Read wetin Mr Ebere Amaraizu talk ontop the matter
“The Enugu State Command of the Nigeria Police Force through its operatives of the 9th Mile Division, today, 6th December, 2016, nabbed a suspected notorious gun runner who allegedly supplied AK-47 rifle to one herdsman, Ibrahim Adamu, earlier arrested by the Command.
“Suspect who gave his name as one Alhaji Samaila Garuba, aka Bakassi, was earlier implicated by Ibrahim Adamu as the one that sold the AK-47 rifle to him.
“Garuba escaped when he got the information about the arrest of Ibrahim Adamu.
“His luck however ran out when intelligence information by the operatives paid off as he was trailed to a motor park situated at 9th Mile in Enugu early this morning, where he was nabbed after several efforts by him to escape.”


Previous
Next Post »

Featured Video