Actor Kunle Remi blast Sport Minister say na im be the most Embarrassing Person for Naija.



The statement wey the Minister of sport mek ontop why dey never pay Super Falcons don turn something else, as Nigerians don mek sure say sense enter the Minister head.



Minister of Youths and sports Development, Solomon Dalung, for yesterday Thursday tell newsmen for Aso rock inside Abuja say the reason why dem never pay the Naija super Falcons wey win the AWCON, be say dey no expect the girls to win AWCON again.

Actor Kunle Remi wey hear this one, para enter IG yan say the minister na the most embarrassing person for this nation, he never finish o, Lere Olayinka wey be media person to Ekiti Governor blast Delung ontop the matter




Previous
Next Post »

Featured Video