CBN don warn Nigerians about MMM say na fraud and mek dey comemot hand from inside.



Central Bank Of Nigeria (CBN) don come out dey warn and dey drow ear give Nigerians dem wey put hand inside MMM.


The head of consumer protection for inside CBN Kadija Kassim come out dey talk this one for one mentoring program for student inside Government Secondary School, suleja.
im say all this wey MMM dey do no dey regulated by any institution.

Im still yan say the MMM wey stand for Mavrodi Mondial Moneybox, say mek Naija people dey very careful, im call this scheme "Wonder bank".

Many Nigeria don enter this online investment scheme MMM.
As he be this scheme go allow you invest monthly and return, you go get 30% of wetin you invest.

But kasim say this one na fraud o, no business for inside Naija support dem.

Read wetin im talk..

“We have heard about the activities of MMM, but I want to warn you against it because they are wonder banks that are not regulated. Desist from their activities because they are fraudulent.”



Previous
Next Post »

Featured Video