#NaijaProverbs "Bring suya, bring suya, na cow body dey suffer am" Read wetin we yan ontop this Suya Proverb.



"Bring suya, bring suya, na cow body dey suffer am". Oya read weti  we yarn ontop this Suya Proverb.


Yes o Kweke o don come with this our Ogboge proverb  wey we believe say you go learn plenty things inside. Cause, everybody for this life even the most richest man need to think or get advice from anybody before im carry out wetin im get for mind. much less us wey we still dey mek end meet. But the koko be say na wetin you use wetin you learn do, nayim matter either good or bad.

Yes "Bring suya, bring suya, na cow body dey suffer am"
if you check this proverb for English he mean "Every action has a consequence"

Now wetin you dey do? mek i ask that question first. Sometimes we country people go think say the thing wey we dey do now no get consequence.
I hear wen won small boy dey say, im won become presido of Naija, one man say im see imself for White House, another say, next year if im no get money, mek im die..

Yes everybody get im own dream but na how you take make plan to achieve that dream nayim matter. Sometimes some people fit even mek plan, na to carry out the plan nayim be their problem. But know say anything you do today get consequences.
You won be president? abi Minister? You won drive that car? abi you won enter Big House?. Na wetin you do today nayim go talk whether he go come to pass.

Some of us fit say we no get money, or my papa no send me go school. My bro OYO be your name.
If you really mean wetin you want, nothing for this life go stop you even if na juju, provided you know wetin you want and you dey work hard to gettam.

Some don work tire, but dem no dey get anything. My brother change the way you dey do things, maybe you no dey do am wella. But always remember to put baba God for everything wey you dey do.
God stand for our back gidigba, bad time or Good time.
But na only people wey know God well dey makam ooo.


Your action today nayim go speak for tomorrow. as we puttam "Bring suya, bring suya, na cow body dey suffer am"


Previous
Next Post »

Featured Video