kim Kardashian Begg for her life as Robbers Tie and Rob Her for her Hotel for Paris



Men wey dress like police tie and rob kim Kardashian, for Paris



Kim Kardashian carry her self waka comot from Paris after Men wey dress like police lock her, tie her, and robb her of  $10 million jewelry, jewelry box wey worth $6.7 million, ring wey worth $4 million, Her purse, two cell phones and 1,000 euros. dey gbege her inside her hotel room. Police tell  La Parisien


Read wetin people magazine talk...
"Five men in ski masks and police jackets were involved in the robbery about 3 a.m. local time Monday, Reuters reports"
 Dey even say she even dey beg  for her life, dey cry say she get children for house. 
approko still say  Kardashian come out from the hotel with two vans, and police escort carry her enter private jet, back to U.S

But the main thing be say dey no give her any injury as she don dey fear say dey go kill her.
Before the Gbege shele, she been go wish her brother Rob Kardashian and im fiancée Blac Chyna congratulobia for their baby shower. 

As she enter her hotel, this gbege come con shele.




Previous
Next Post »

Featured Video