Government don draw ear give Civil Servant for Kano, say mek dem no protest for Salary



 Mustapha Fagge wey be the Public Relation Officer, office of Head of service for Kano State sign one statement,  wey say mek civil servant wey dey never pay salary no protest.


The statement dey drow Ear give  Civil servant, say mek dem no protest at all

As the matter be some yeye workers send text message give Workers wey dey never pay salary, say mek the workers Gather dem self enter Audu Bako Secretariat on Friday, Sept. 23 so dem go  protest.. 

Head of Service con read for the statement say mek dem no reason that text message, mek dey forgetam.
The statement con still read say the government  don alert Security dem, say mek dem deal with anybody wey chuk hand do protest.

The statement say anything wey concern salary wey dem never pay na the hand of the Ministry of Finance he suppose to dey. as na wetin the civil service rule talk

“We are calling on affected workers to channel their complaints or grievances through their respective ministries, departments and agencies, MDAs.“This is the proper way as contained in the Civil service rules”


Previous
Next Post »

Featured Video