Colombia nack Naija belle for the last group stage for the Rio 2016 Olympic



Colombia don nack Nigeria Olympic football Team to 2-0 for their third and final group match for Rio 2016 Olympics.



Daniel Akpeyi wey be the goal keeper no quick run comot from im area go catch ball as Teofilo Guitierrez carry ball enter penalty box for the fourth minute, the colombia player con nack naija belle.
Akpeyi for the 63rd minute nack one colombia player for ground wey carry ball won score. referee say, Akpeyi wetin happon?. Referee carry ball go put for the area where Akpeyi for nack the Colombian down. na their this player for give Naija another belle.

As the matter be, Samson Siasia change players five times wen dey win Japan and Sweden, wey carry dem qualify enter the knockout stage. He be belike say this changes wey Samson do nayim make Colo fit win Naija.

The team no too shake body, to play this match wella. as dey no collect ball pass well well or say mek dey put some kind space, to mek sure say dem score.
But since we don win other match  Naija still dey top for the group.

Previous
Next Post »

Featured Video