Bloomberg and IMF say As Naira just dey fall yakata against dollar. na so naija fall comot from largest economy for Africa.
Bloomberg and IMF nayim comout dey give us this tory say South Africa don dey largest, as the aproko talk say Sourth africa don gain more 16% against dollar since the beginning of 2016, say naija don loss more than third of im value when CBN carry their new policy ontop Foreign Exchange for June.
The report say south Africa economy dey $301 billion for the rand current exchange rate with dollar, as we dey talk. while Nigeria GDP dey $296 billion, this one base on gross domestic product for 2015 wey the International Monetary Fund publish.
oil price self don go down, as dey no dey produce oil wella as befor sake of the gbege wey militate dem carry hand do for Niger Delta region. and oyibo money no dey Naija again. all this one nayim chuk leg for same trosuer dey mek naija economy go down by 0.4 percent for three months since this year start.
Godsgift Ajomafuwe is an handsome young smart passionate optimistic individual, a social media Manager, a content developer, Photographer, leader who has worked and voluntered for alot of organization.he belives our life is what we make of it.
Related Post
Bill Gates, Warren Buffett, Mark Zuckerberg, & More come out for Forbes 2017 Billionaires ListMicrosoft Founder Bill Gates, don come first for the fourth time again for Forbes 2017 Billionaires
Goodluck Jonathan don yarn say PDP, go get up from sleep again.Former Presido, Goodluck Jonathan, don comout dey yarn say, Peoples Democratic Party (PDP) go get u
Lagos state Government don plan to teach one million people coding for three years.Bank-Olemoh yarn this one for one interview, wey im get with the News Agency of Nigeria (NAN) for &
Senate don confirm say, Justice Walter Onnoghen, nayim go be the new Chief Justice of Naija.. Today Naija senate don confirm am say, Justice Walter Onnoghen, nayim go be the new Chie
ConversionConversion EmoticonEmoticon