Kweke oooooo!!! hmmm Arm Robber cut DPO Ear comot and con nakedam join
Some arm robber catch one DPO wey be the Divisional Police Officer inside Ajali for Orumba North Local Government Area inside Anambra State wey dey go gbege dem for their corner.
He never finish o, dey Nakedam con cut im Ear comot
The Police command spokesman for the state Awkuzu Okechukwu say the DPO carry im and im team dem go where the arm robbers dem dey, for Nanka community. na there the arm robbers for Gbege dem.
Im say dey arrest two of the arm robbers wey names na Ifedilichukwu Nwankwo, Chidi Nwankwo and Udoye Kenechukwu
Awkuzu Okechukwu say na God save the DPO. say im dey under treatment sha.
The PPRO say these gangs dem don dey do plenty bad things for the area including Rape,Kidnap and even kill people. im still say na these same gangs kill won Okechukwe Udezuka for onisha for 2014.
Read wetin im talk
“A team led by the DPO was ambushed at Nanka by the gang, when they went to effect the arrest. The DPO was robbed of his handset and money. He was stripped naked and one of his ears chopped off. His official uniform was equally torn to shreds. The gang also burnt down a police Hilux SUV.
ConversionConversion EmoticonEmoticon