mek ona bear with presido Buhari;Abdulrazak Namdaz



The Chairman for the Committee ontop Media and Public matter,Abdulrazak Namdaz, for inside the House of Representatives, don tell naija people say mek dem bear with  Presido Muhammadu Buhari as him dey mek sure say Nigeria better.

The lawmaker talk this one for one forum with journalists dem for inside Yola.

Namdaz, wen dey represent Mayo-Belwa/Ganye/Toungo/Jada Federal Constituency for Adamawa, say the hardship wen we dey face now sayy he dey affect obodo the world say no be only nigeria deyy face wahala like this.


read wetin him talk

"We need to bear with President Buhari as he is trying to put things in shape, we must realise that he is not a magician to change things overnight.
"We should be patient and accord government at all levels the needed support and cooperation to face the numerous challenges at hand,’’ him talk.

Namdaz say this year budget go bring change for inside Nigeria,him con still say dey don carry about N46.9 billion out for capital project wey dey won do for north say from inside N5.9 billion na for Adamawa project.
him con still sey say the project wey him bill for him constituency for this year budget na the completion of Mayo-Belwa power substation wey Transmission Company of Nigeria go do, dey go still do Mayo-Belwa-Zing road and con  rehabilitate the Federal Government College, Ganye.

Read him talk...


"I will also continue with my youth empowerment programmes for people in my constituency.
"I want to use this opportunity to urge the people of Adamawa to come out emmase to support our (APC) candidates in the coming local government election in the state, " Namdaz talk.

Previous
Next Post »

Featured Video