Lagos state police gbag man wey dey sell fresh human skull for N1million.



The Lagos state police command don gbag one 45-year-old Lucien Tusume, wey be ritualist with human skull, the 45 years yarn say im dey sell dem for N1million each.


Police arrestam for Iraye village inside Sagamu area for Ogun State.

As the mattet be, wey mek dem fit catch the man, the Lagos State Police Public Relations Officer, Olarinde Famous-Cole, yarn say some policemen, dress like people wey won buy market, go ask the man human skull.

The man agreed say, im go sell dried skull for N150,000 give the police, but the officers dem price the skull go N81,000.

The man con later carry the dried human skull go give the ‘buyer" , na there dem for arrest am after dem payam.


  1. When police dey chuck eye inside im matter, the man yarn say im dey sell dried skull for N80,000 and N120,000, say fresh human skull na N1million.


Famous-Cole, yarm say dem don carry the man enter the State Criminal Investigation and Intelligence Department, Yaba, where dem go look into how and where im for get the human skulls.

Previous
Next Post »

Featured Video