Police for Ghana don yarn say, Tonto husband no beat her, after she yarn say her husband beat her anyhow for Ghana.



Earlier this week, Tonto Dikeh enter interview, where she for yarn about all her marriage wahala with her husband, Olankunle Churchill. she yarn about the badness wey her husband dey do ontop her.

Tonto Dikeh and Oladunni Churchill... when the going was good

For the interview, Tonto yarn say, her husband dey touch light another woman, and e fit be say, her husband get another pikin for different women.

She yarn about the beating wey her husband beat her for Ghana, sote, she run enter Ghana Police station.
But the koko be say, tori don come out dey say, Tonto Dikeh dey lie about the beating for Ghana, as Ghana radio station, Joy News yarn, say na lie say

For one interview, with the police officer, wey dey chuck eye for the case, im yarn another tori give public, ontop wetin shelle for Ghana

Read wetin Police talk
........
‘On the 9th of June 2015, a Nigerian called Churchill Dunni…reported to this divisional headquarters that his fiancee then, called Tonto Charity Dikeh has called damage to his property in his house… We proceeded to the place and we found out that some many things in the house had been damaged by the lady. We inspected it as our procedure demands. We took her to the station, she admitted the offence.’

The police still say, Tonto Dikeh do gragra with dem, so Churchill withdraw.

As he be, this na another tori wey concern this marriage wahala, as we no know who dey lie, or who dey at fault, ontop Tonto and Churchill marriage.

Since the interview, wey Tonto Dikeh get with Media Room Hub, enter town, many Nigerians don support her, and dey hail her for say, she come out, yarn wetin dey pain her.

Previous
Next Post »

Featured Video