Oh my Lawd!!! Mama stab her 8 months pikin for belle with knife inside Ebonyi state.



According to wetin we hear, one 8-month-old pikin, nayim mama stap for belle with Knife.

Horror: Woman stabs own 8-month-old baby in Ebonyi

This One shelle for Abakaliki, as he be, the woman, wey be the wife of one police sergeant, for police barracks inside Abakaliki, stab her 8 month son for belle, with knife, con leave the knife inside the pikin belle.

Na there, one neighbour wey see this badness for shout kweke O! for people to come see.

Tori say,  the woman dey suffer from mental craze, as the craze dey come, dey go.
So dem carry her enter hospital so dem go look inside her matter wella.

One medical practitioner, wey dey the hospital, say the boy don loss plenty blood, and the knife still dey inside im belle.

One Facebook user, wey name na Omeri Nwachi, say im dey there, when dem carry the pikin come.

Read wetin im yarn.

“A woman stabbed this baby, you can’t imagine that it was true and I actually snapped it myself. The baby is still alive and was being prepared for surgical procedure. Please pray for the survival of this baby”.

But thank God for the small pikin life sha, as dem do surgery ontop am, and e go well, dem don comot the knife from im belle.


The Ebonyi state Police Public Relations Officer, DSP Jude Madu, don comfirm this one, con say, dem don carry the mama, enter psychiatric hospital, so dem go chuck eye inside her matter wella.

Image may contain: people sleeping and indoor


Previous
Next Post »

Featured Video