One Akure Chief Magistrate Court, don sentence one 32 year old man, wey name na Waleola Sunday, and im be pastor for Cherubim and Seraphim (C&S) Church, inside Akure, Ondo state,

As he be, dem give am three years for prison, for say im dey touchlight one small boy, wey dey stay around im church, for Oke Aro area, inside Akure for the state capital.
officers for the Nigerian Security and Civil Defence Corps (NSCDC) inside Ondo state, nayim arrest am, after dem hear tori ontop the matter.
As court dem dey judge im matter, the legal officer for NSCDC, wey name na Ebiriku David tell court say, the tori wey dem fine, show say Waleola na gay,
say im dey touchlight small small boys, say this badness dey against the ondo state child Right 2017
Waleole for the court say yes ooo, na true, i touch light the small boy, but na devil cause am ( Eh you and devil go enjoy una sef for jail)
Read werin im talk
"I always enter public schools during their break hours to approach most of these male students before carrying out the act. And after this, I would take them to the bush and seduce before they returned back to their classes. I believe it's devils work because I would always come back to my senses after I molested the little boys,".
When Magistrate Bob Manuel, dey judge the matter, im put the man for 3 years for prison, for Olokuta Prison yard inside Akure.
ConversionConversion EmoticonEmoticon