Twenty three persons nayim die, as serious accident shelle, with one Toyota Canter moto and one Okada.

As he be, this one shelle for Tunga Giwa – Ruwa road, inside Shanga Local Government Area for Kebbi State.
The driver wey drive the Toyota Canter moto, try to dough one pothole, na there im for go jam okada, con somersault, kill the okada man and 23 people wey dey inside the moto.
Alhaji Garba Salihu,wey be oga for that area, tell Governor Atiku Bagudu say, the market people dem, dey come from Tungan Giwa market, before this badness shelle.
Salihu yarn say, the moto, run enter one big hole, con catch fire.
Im still yarn say na 23 persons wey dey inside the moto, nayim die. and 8 other people, dey inside General Hospital, dey collect treatment.
The governor do eyah ontop people wey survive, say im go mek sure, im settle their medical bill, and do other things, for dem to beta.
The Kebbi State Police talktalk person, Mustapha Suleiman, tell PUNCH say, this accident shelle for around 10.30pm on Monday.
Read wetin im talk..
“The bus driver was at top speed when the motorcycle rider ran into the vehicle. The bus somersaulted and burst into flames. All the traders were burnt beyond recognition; so we cannot tell how many were males and how many were females. There are seven survivors at a hospital and they are in critical condition.”
ConversionConversion EmoticonEmoticon