Mama Kill her only son, after she mistakenly give her son kerosene, think say na water.



One Mama nayim wey hear say kill her only boy pikin, after she mistakenly give her pikin Kerosine instead of water.


Ata Buhari, wey be Oni kerosine, give her pikin kerosene drink, after the pikin don dey cry say, im wan drink water, nayim she carry wan plastic bottle, wey she keep for one side of her shop, give the pikin, but this bottle, nayim kill the pikin.

This one shelle for on Tuesday, around 10am, inside Iguma street, for Medical stores Road, inside Benin, Edo state.

According to wetin we hear, Ata Buhari, think say na, water dey inside the bottle, kaki na kerosene dey inside, con go give her pikin wey name na Isreal  Buhari drink.

After the pikin drink one round, nayim im shout kweke oo, na their the mama for know say, na kerosene, she give her pikin, dem give the pikin, palm oil drink, But as dem rush am reach Hospital, im don already die.

We still hear say, the papa of the pikin, wey name na Hassan Buhari, 36, from Kogi state, nayim dey call enter the hospital, but im waka come see im pikin dead body.



Previous
Next Post »

Featured Video